Revision 16744 of "White Money" on pcmwiki

'''Hazel Oyeze Onou''' wey pipul sabi as '''Whitemoney''' he bi Nigeria singa, songrita an reality TV star. Na im bi di winna of Big Brother Naija season 6
==How He Tek Stat Wok==
Whitemoney na lgbo man from Enugu state Nigeria. Bot he gro op for Kaduna state Whitemoney no tu go skul bot he go reach NECO level.
==How He Tek Stat Wok==
As we tok bifo Whitemoney gro op for Kaduna state he kom muv kom Lagos to kom luk for wok,he do meni bizness like commashal photography,barberin, repairin of generator an fixin telecommunications towers among oda dem. He folo invest for importin an sellin of shoes.
==Musik Wey He Du==
Whitemoney produce smol song dem like "Rosemary" (2018) "Your life" (2018) an "My Heart" (2021) For 3th Disemba 2021 he release single "Selense" wey bi sey na masterkraft produce am, dem release am wit di vidio.
==Big Brother Naija==
Whitemoney enta di 6th season of Big Brother Naija as di 5th contestant for 24 julai 2021. Durin di season final of di show for 3th Oktoba 2021 dem declare Whitemoney winna bikos e score 47% of di final votes wey pas liquorose vote wey bi 22.99% for dis reasin dem kom given Whitemoney di #90million grand prize  
==Fim Wey He Akt==
{| class="wikitable sortable"
|+ Caption text
|-
! Year !! Title !! Role !! Notes
|-
| 2021 || Big Brother season 6|| Himself || Reality Show
|}